Thursday 26 January 2017

Food Hut Family Meeting πŸŽ€πŸ”Š

Excuse me today as I may be going into some Lingo briefly, pidgin English to be precise.

Oya o, make una ready for our meeting o. We go dey do many fun things together. 

Which one be your country or your town sef? Eh hen make una ready as we go dey do competition, interviews in form of 


'Come Chop' shows

where you go get chance take show people say better dey for your country, abi ya village sef.

That na only de start of the 'tory, prizes go dey 

-for your display,
- wetin you teach us 
-and how yummy we feel say e go be (unless true true you invite us come chop). 
-Our brother and sister dem wen get restaurant and shop go show their hand too.

To follow do these competition dem, you go need to put your name down here say you be part of The Food Hut Family.
 I hope say una go make am fun. 
Na una go compete, na una family go still vote too.

So go tell your all your friends (by sharing this post). Begin dey think the kind thing you fit take show your country or any other African or Caribbean food wen you sabi cook or you wan introduce us to. You sef, no forget to put your name down by following this page too. If not, how you go fit prove say you be part of the family πŸ˜‘?

Oya o..... begin follow/ suscribe now. Na so the party go take start. ( I go give more details about the rules later)

(😡😢confused, ask a friend or else wait up, translation coming nextπŸ˜‰)

Una stay well till anoda time.

Your sister Fally Jay for The Food Hut.

No comments:

Post a Comment